Yu nor bilive sey mi and my Papa na di same? As E dey inside mi, na so I dey inside am. Di word wey I dey tell una so, I nor dey tok am with my own pawa, but na my Papa wey dey inside mi, dey do all dis mirakle thru mi.
I nor go fit do anytin with my own pawa, but na wetin I dey hear from my Papa, naim I dey use take judge. Any judgement wey I give, na true one, bikos I nor dey do my own tin, but I only dey do as my Papa send mi.
Den Jesus sey, “Wen una don karry mi put for cross, una go know who I bi. I nor just dey do anytin wey I like, but I dey always do wetin my Papa tell mi.
Pesin wey nor dey follow wetin Christ tish, but dey find oda yeye tishas, nor know God. But pesin wey dey obey dis tishing, get both di Papa and en Pikin.