Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 7:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 Di Jew oga dem sopraiz and dem kon dey sey, “How e take know dis tins wey e dey tish so, as e bi sey e nor go skool at-all?”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 7:15
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Or if una gi-am to pesin wey nor sabi read make e read am, e nor go fit, bikos e nor sabi read.


Den e rish en village kon bigin tish di pipol for dia sinagog. Dem sopraiz well-well kon sey, “Where dis man from get dis kind sense and pawa wey e take dey do mirakle sef?”


So wen dem hear wetin e tok, dem kon waka leave am.


Wen di pipol hear as Jesus dey tok, dem sopraiz for wetin e dey tish.


Evribody wey hear wetin Jesus dey tok kon dey sopraiz for di way e undastand and di ansa wey e dey give.


Evribody dey tok good about Jesus, dem sopraiz for di sweet-sweet word wey dey kom out from en mout. So dem kon ask, “Dis nor bi Josef pikin?”


Di Jew oga dem send priests and Levi pipol make dem go ask John sey, “Who yu bi sef?”


Di Jew oga dem kon dey ask pipol, “Where e dey?”


But nobody fit tok out, bikos dem dey fear di Jew oga dem.


Di sojas ansa, “Wi neva si anybody wey tok like dis man before!”


As Paul dey defend ensef, Festus kon shaut, “Yu dis Paul, yu don dey kraze o! All di plenty book wey yu know don dey won make yu mad!”


Di oga dem sopraiz wen dem si how Pita and John take tok even doh dem nor go skool. So dem kon know sey dis na di pipol wey don follow Jesus Christ waka.


Wen evribody wey know am before si am dey tok like profet, dem kon dey ask each oda, “Wetin dey happen to Kish pikin? Saul sef don bi profet?”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ