Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 7:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 Wen di feast don rish half, Jesus enter di temple kon dey tish.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 7:14
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“Si! I dey send my messenja kom and e go prepare di way for mi. Den Oga God wey una dey find, go kom en temple at wons.


“ ‘For di sekond day, make una give twelf yong melu, two ram and fourteen man lamb wey bi one year and dem must dey okay.


“ ‘For di third day, una go give eleven melu, two ram, fourteen man lamb wey bi one year and dem must dey okay,


Den Jesus enter di temple aria kon drive all di pipol wey dey buy and sell inside di temple, e skata di tabol and chair wey di pipol dey take shange money and sell dove.


By dis time, Jesus tell di pipol wey follow Judas kom sey, “Una karry swod and stik kon arrest mi like sey I bi tif? I dey tish inside di temple evriday, but una nor arrest mi.”


Jesus kon dey tish evriday for di temple. Di priest oga dem, di law tishas with di big leaders among di pipol kon dey find how dem go take kill Jesus.


Jesus kon ansa am, “Na for publik I tok wetin I tish. Na inside sinagog and Temple where all di Jew pipol dey gada, na der I for dey tish. I nor tok anytin for sekret.


Afta dis, Jesus kon si di man inside di temple. So e kon tell am, “Look, yu don well naw, make yu nor kommit sin again, oda-wise, di tin wey bad pass wetin do yu before, go happen to yu.”


Di time kon rish wen Jew pipol dey do dia feast wey dem dey koll Tabanako Feast.


As Jesus dey tish for di temple, e kon shaut sey, “Una know mi and di place wey I from kom, nor bi my pawa I take kom, na God wey send mi naim bi di korrect Pesin. But una nor know am.


For di last day for di feast, wey bi di biggest day, Jesus stand kon shaut, “If wota dey hongry anybody, make e kom meet mi.


For early morning, e enter di temple. Plenty pipol gada for der and e kon sidan dey tish dem.


Jesus dey tok to dem near di box where dem dey put ofrin money, wey dey inside di temple. Nobody fit katch am, bikos en time neva rish.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ