Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 7:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Dem kon dey tok among demsef. Some sey, “Jesus na good pesin”, but odas sey, “E dey play pipol wayo.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 7:12
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E good make disciple bi like en tisha and savant bi like en oga. If dem dey koll oga for en house ‘Belzibub (wey mean demon oga),’ wot of di pipol wey dey di house? Dem nor go koll dem bad name too?”


So dem kon dey try to arrest Jesus, but dem dey fear, bikos di pipol bilive sey na profet e bi.”


dey sey, “Oga God, wi remember sey wen dat wayo man still dey for dis world, e tok sey, ‘Afta three days, e go wake-up.’


Jesus kon tell am, “Why yu dey koll mi good? Nobody good escept God.


Wen di soja oga si wetin happen, e kon praiz God sey, “True-true, dis man na good pesin!”


E get one man for di kansol, wey bi Josef and e kom from Arimatea wey dey Judea. E bi betta pesin wey dey do wetin God like and e dey wait for di time wen God Kingdom go kom.


Wen pesin dey good, na di good tins wey dey inside am, dey make am bear good fruits, but bad pesin, na di bad tins wey dey inside am, dey am make bear bad fruits, bikos na from wetin full inside pesin mind, naim en mout dey tok.


Fear katch all of dem and dem kon dey praiz God sey, “Na big profet kom meet us so-o!” and “God don kom help en pipol!”


So wen di pipol si di mirakle wey Jesus do, dem kon dey tok among demsef sey, “True-true, dis man na di profet wey God send kom dis world.”


Wen di Farisee pipol hear pipol dey tok about Jesus, dia oga and di priests kon send sojas go arrest am.


Den di Farisee pipol kon ask di sojas, “Abi, e don deceive una too?


Dem kon ask am, “Abi na Galilee yu too from kom? If yu look well, yu go si sey know profet go fit kom from Galilee.”


Some Farisee pipol kon sey, “Nor bi God send dis man, bikos e nor suppose to do any work for Sabat Day.” But odas sey, “How pesin wey dey kommit sin go fit do dis kind mirakle?” Dis argument kon make di pipol divide.


Banabas na betta pesin, di Holy Spirit dey inside am and e get faith well-well, so many pipol kon bigin follow Jesus Christ.


Nobody go won die for anoda pesin wey dey good for God eye, aldo somebody go fit die for pesin wey good well-well.


Make una nor use vexnashon take work for God,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ