10 But wen en brodas don go di feast, Jesus kon go der too, but e nor let anybody know sey e dey der.
Oga God, I love yor temple; di place where Yu dey and where yor glory for dey shine.
‘My God, I won do wetin Yu wont, bikos Yu rite yor laws for my heart.’ ”
So, to keep kwayet for dis kind evil time, naim bi di best tin to do!
“Si! I dey send una go like sheep for where plenty wiked animals dey, so make una dey wise like snake and gentol like dove.
As Jesus still dey tok, en mama and brodas kon stand for outside, bikos dem won si am.
Jesus ansa, “Make e bi so naw, e betta make wi do evritin wey God wont.” So, John kon baptize am.
Wen Jesus family hear wetin dey happen, dem kon go hold am, bikos pipol dey sey, “E don dey kraze.”
Bikos of dis, Jesus nor kon dey waka for Judea as e dey do before, but en and en disciples kon go stay for di town wey dem dey koll Efraim, wey near wildaness.
Jesus brodas kon dey tell am, “Komot for here go Judea, make yor disciples si di mirakles wey yu dey do.
(Even en brodas nor bilive wetin Jesus dey do.)
Afta e don tok finish, e kon stay for Galilee.
but wen di rite time rish, God kon send en pikin wey woman born under di law,