64 But some of una nor bilive.” (From biginnin, Jesus don know di pipol wey nor go bilive and di pesin wey go sell am give en enemy.)
Simon wey bi Zealot (pesin wey dey fight for en kountry) and Judas Iskariot wey sell Jesus Christ.
But una nor bilive mi bikos una nor bi my sheep.
Bikos Jesus know evritin wey go happen to am, e kon ask dem, “Who una dey find?”
bikos I know sey, una nor love God for inside una heart.
As I don tell una, una dey si mi, but una nor bilive.
Wen Jesus many disciples hear wetin e tok, dem kon sey, “Dis tin wey Jesus dey tok so hard well-well o-o! Na who go fit undastand dem?”
Wen Jesus know sey en disciples dey komplain about wetin e tok, e kon ask dem, “Wetin I tok so dey make una vex too?
Afta dis, Jesus many disciples kon stop to follow am.
Jesus ansa dem, “Na groun una from kom, but mi, na heaven I from kom. Una kom from dis world, but I nor kom from dis world.
Una nor know am, but I know am and if I sey I nor know am, I dey lie like una. I know am and I dey follow wetin e dey tok.
and E know sey na so e go bi.
God know doz wey E don choose, so E don make dem bi like en Pikin, so dat en pikin go bi di first-born.
But God strong foundashon still stand and dem rite put sey, “God know en pipol and evribody wey bi Christ own, must stop to do evil.”
Nor-tin wey God kreate fit hide from am and evritin dey naked to God, bikos wi go must tell am how wi live awa life.