Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 6:47 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

47 I dey tell una true word, anybody wey bilive mi, don get life wey nor dey end.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 6:47
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

and di pesin wey bilive mi for dis life, nor go ever die. Marta, yu bilive wetin I tok so?”


Afta sometaim, di pipol for dis world nor go si mi, but una go si mi and bikos I dey alive, una go dey alive too.


“God love di pipol wey dey dis world well-well, so E kon send di only pikin wey E get to us, so dat anybody wey bilive am, nor go die, but e go get life wey nor dey end.


Anybody wey bilive am, God nor go kondemn am. But di pesin wey nor bilive am, God don kondemn am already, bikos di pesin nor bilive God Pikin name.


Pesin wey bilive di only pikin wey God get, go get life wey nor dey end. But pesin wey nor bilive Man Pikin, nor go get life at-all. God go always dey vex with dat kind pesin.”


“I tell una true word, di pesin wey take wetin I tok and bilive sey na di Papa send mi, go get life wey nor dey end and e nor go enter hell-fire, but e go get life wey nor dey end.


Make una nor work for food wey nor dey last, but for food wey go give una life wey nor dey end and dat kind food, na only Man Pikin go fit give una, bikos na-im God send kom.”


Wetin my Papa wont bi sey, anybody wey bilive en pikin, go get life wey nor dey end and I go wake am up for di last day.”


Dis na di bread wey kom from heaven, so dat anybody wey chop am, go get life wey nor dey end.


Na mi bi di bread wey kom down from heaven. Anybody wey chop dis bread go live forever. Na my flesh bi di bread wey I go give di pipol wey dey for dis world.”


Di pesin wey go chop my flesh and drink my blood, don get life wey nor dey end and I go take am up for di last day.


Dis na di bread wey kom down from heaven, e nor bi like di bread wey una grand-grand papa dem chop and afta, dem still die. Di pesin wey go chop dis bread nor go ever die, but e go live forever.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ