Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 6:44 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

44 Nobody go fit kom meet mi with en own pawa, unless my Papa wey send mi draw am kom meet mi and I go take am go up for di last day.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 6:44
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Draw mi follow yu! Make wi kwik komot here! Make di king take mi go en room. Awa king, wi dey happy well-well, bikos of yu and wi like yor love pass wine. Yes, di yong wimen dey honor yu and dat na di rite tin to do.


Black man fit shange en skin kolour, abi leopard fit komot di mark wey dey en body? If dem nor fit, den e go hard for wiked pesin to do good, bikos na only to do bad tins, e sabi.


I go kom help dem, bikos I love Israel pipol well-well and na dis make mi still dey show dem my love wey nor dey end.


I draw dem near body with love and kindness. I remove dia heavy load from dia head kon bend down feed dem by mysef.


Una, snake shidren! How una won take tok good word since una dey wiked? Na wetin full pesin heart, naim en mout dey tok.


Den Jesus tell am, “God go bless yu, Simon, Jonah pikin, bikos na my Papa for heaven show yu dis tin, nor bi human being.


But as for mi, if una karry mi go up for cross, I go draw evribody kom meet mi.”


How una go fit bilive wen una dey praiz each oda and una nor kare for di praiz wey only God fit give.


Jesus ansa, “Make una nor komplain about mi give each oda.


Na so di profets rite sey, ‘God go tish evribody.’ Anybody wey hear wetin my Papa tok, go kom meet mi.


So Jesus kon sey, “Na bikos of dis I tell una sey, nobody go fit kom meet mi with en own pawa, unless my Papa let am kom.”


Na bikos una nor won asept wetin I dey tish, naim make una nor fit undastand wetin I dey tok.


God don give una dis sign, nor bi only make una for bilive Christ, but make una for still sofa for am,


Bikos wen dem baptize una, dem beri una with am and una follow am raiz-up thru di faith wey God pawa dey give and na dis God raiz am up.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ