Nor bi di karpenter, wey Mary born bi dis? Nor bi en brodas bi James, Josef, Judas and Simon? Nor bi en sistas dey with us so?” So dem kon dey vex for am.
Wen Filip si Netanel, e tell am, “Wi don si di pesin wey Moses and di profets rite about for dia book sey, ‘En name na Jesus, wey en home-town bi Nazaret and na Josef pikin e bi.’ ”
Awa grand-grand papa dem wey follow God waka before, na from dem dis pipol from kom. So I dey pray make dem praiz God wey dey rule evritin forever and ever! Amen.