Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 6:39 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

39 Wetin my Papa wey send mi wont, na make I nor luz anybody wey e give mi, but make I for take dem go up for di last day.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 6:39
29 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I go choose rulers wey go kare for dem. My pipol nor go fear at-all and I nor go ponish dem again. Mi, wey bi God, don tok.”


I tell una true word, e go betta for Sodom and Gomorrah pipol for judgement day, pass di pipol wey dey for dat town.”


Na like dis too yor Papa for heaven nor wont make any of en shidren lost.”


“Make una nor fear, una wey bi small sheep, bikos una Papa go happy to give una di kingdom.


Anybody wey rijet mi and nor do wetin I tok, God go use dis my word judge am for di last day.


Wen I dey with dem, I keep dem with yor name. No one lost, escept di one wey yor word sey e go perish.


Just as yu don give mi pawa ova all di pipol for di world, na so too I go give life wey nor dey end to evribody wey yu give mi.


Papa, I wont make di pipol wey yu give mi stay with mi for where I dey, so dat dem go si di glory wey yu give mi, bikos yu love mi before yu kreate di world.


I don make di pipol wey yu give mi for dis world know yor name. Na yor own dem bi before yu give dem to mi and dem don obey yor word.


I dey pray for di pipol wey yu give mi, bikos dem bi yor own, but I nor dey pray for di oda pipol wey dey inside di world.


(E tok dis word make e bi sey wetin dem rite for God word na true, “I nor lost anybody among di sheep wey yu give mi.”)


“So, make dis word nor sopraiz una, bikos di time dey kom, wen all doz wey dey inside grave go hear di pikin vois,


Anybody wey my Papa give mi, go kom meet mi and wen e kom, I nor go ever drive am.


Wetin my Papa wont bi sey, anybody wey bilive en pikin, go get life wey nor dey end and I go wake am up for di last day.”


Nobody go fit kom meet mi with en own pawa, unless my Papa wey send mi draw am kom meet mi and I go take am go up for di last day.


Di pesin wey go chop my flesh and drink my blood, don get life wey nor dey end and I go take am up for di last day.


If God Spirit wey raiz Jesus Christ from deat dey inside una, den en wey raiz Christ from deat, go give una body life, bikos of en Spirit wey dey inside una.


God go raiz us from deat with di same pawa wey E use take raiz Jesus.


But God strong foundashon still stand and dem rite put sey, “God know en pipol and evribody wey bi Christ own, must stop to do evil.”


Di prayer wey dem take faith pray go save di pesin wey nor well and God go make am well. And if e kommit any sin, God go forgi-am.


and en pawa dey protet am thru faith and wi dey wait for di salvashon wey go kom for di time wen di world go end.


Dis leta na from Jude, Jesus Christ savant and James broda. To di pipol wey God don koll, wey Papa God love don wrap like klot for Jesus Christ body.


Anybody wey dey porshu and won kill yu, di Oga yor God wey dey heaven go protet yor life and nor-tin go happen to yu. But e go skata and kill yor enemies, wons and for all.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ