36 As I don tell una, una dey si mi, but una nor bilive.
“Abraham ansa am, ‘If dem nor gri listin to Moses and di profets, dem nor go still listin, even if pesin wey don die go back go meet dem.’ ”
Aldo Jesus don do many mirakle for dia front, dem nor still bilive am.
If to sey dem nor si di mirakle wey I do, wey nobody don do before, dem for nor dey guilty for dia sin. But afta dem don si di mirakles, dem still hate mi and my Papa.
Jesus ansa dem, “Make I tell una true word, na bikos of di bread wey una chop naim make una dey find mi, nor bi bikos of di mirakles wey una si.
Dem still ask Jesus, “Wish kind mirakle yu go do make wi si, make wi for bilive yu?
Anybody wey my Papa give mi, go kom meet mi and wen e kom, I nor go ever drive am.
Wetin my Papa wont bi sey, anybody wey bilive en pikin, go get life wey nor dey end and I go wake am up for di last day.”
But some of una nor bilive.” (From biginnin, Jesus don know di pipol wey nor go bilive and di pesin wey go sell am give en enemy.)