28 Dem kon ask am, “Wetin wi go do to make God happy with us?”
make una nor make big mistake. Na una sey make I pray give di Oga awa God and una promise sey una go do evritin wey E kommand.
One man kom meet Jesus, ask am, “Tisha, wish good tin I go do make I for fit enter God Kingdom?”
One man wey sabi di law well-well kon get up test Jesus, “Tisha, wetin I go do to take get life wey nor dey end?”
Make una nor work for food wey nor dey last, but for food wey go give una life wey nor dey end and dat kind food, na only Man Pikin go fit give una, bikos na-im God send kom.”
Jesus ansa, “God wont sey make una bilive di pesin wey E send.”
E bring dem kom outside kon ask, “My oga dem, wetin I go do to dey save?”
Wen di pipol hear dis prishin, e trobol dem for mind well-well and dem kon ask Pita and di rest apostles, “Awa brodas, wetin wi go do naw?”
Naw, make yu get up go inside di town and dem go tell yu wetin yu go do.”
Make una go by unasef kon listin to wetin God dey tok. Den make una kon tell us evritin wey E tell una and wi go listin and obey.”