43 I kom with my Papa name and una nor gri asept mi, but if anoda pesin kom with en own name, una go asept am.
Oholibah, yu won still do di ashawo wey yu do for Egypt wen yu bi small girl? Where men for dey play with yor breast and sleep with yu.
Lie-lie messiahs and profets go kom do big-big mirakles take deceive pipol. If e possibol sef, dem go deceive pipol wey God choose.
Many pipol go kom with my name dey sey, ‘I bi Christ wey bi di Mezaya’ and dem go deceive many pipol.
Jesus ansa dem, “I don tell una and una nor bilive. Di tin wey I take my Papa name dey do, dey bear witness for mi.
Papa, make yu honor yor name.” Den one vois tok from heaven sey, “I don honor am before and I go honor am again.”
“God love di pipol wey dey dis world well-well, so E kon send di only pikin wey E get to us, so dat anybody wey bilive am, nor go die, but e go get life wey nor dey end.
bikos I know sey, una nor love God for inside una heart.
Nor bi to do wetin I wont make mi kom down from heaven, but na to do wetin my Papa wont.
So nor bi yu bi dat Egypt man wey start wahala kon karry 4,000 men wey dem dey koll ‘Asassins’ go inside wildaness?”