Even if Yu sorry for wiked pipol, dem nor go still learn how to do wetin dey rite and even for where raitious pipol dey rule, wiked pipol still dey do wiked tins; dem nor dey si God glory wey dey kom.
God wey bi di Holy One and di Pesin wey save Israel; di Pesin wey wi dey sin against; wey dey serve rulers, dis na wetin E tok, “Kings go si yu kon stand, prince go bow down, bikos of God wey dey good wey bi di Holy One for Israel and naim choose yu.”
Make Christ word stay inside una and make una dey tish each oda with wisdom wey go make una heart strong. Make una dey sing psalms, hymns and spiritual song and dey do all dis tins to really tank God from una heart.
Dis law wey God give yu must nor komot from yor mout! Yu must dey read and tink of am evriday and nite, so dat yu go fit obey evritin wey dey inside. Den yor way go dey rite and evritin go betta for yu.
I don rite give una, my shidren, bikos una don know God. I don rite give una wey bi papa, bikos una don know di pesin wey dey alive since God kreate di world. I don rite give una yong pipol, bikos una dey strong and God word dey inside una, as una don win Satan.