God pipol wey don die, go kom back to life! Dia body go raiz-up again. So, all of una wey dey grave, make una wake-up kon shaut with happiness, bikos una go grow well like grass wey dew fall put and di eart go bring back evritin wey don die.”
I nor go save dis pipol from grave or save dem from deat pawa. So deat, make yu bring all yor wahala kom! Yu grave, make yu bring all yor distroshon kom, bikos I nor go pity for dis pipol again.
Jesus kon sey, “Woman, make yu bilive mi, di time dey kom, wen pipol go woship God for anywhere wey dem dey, nor bi only for dis mountin or for Jerusalem.
Bikos di Papa get strong love for en pikin, e dey always show am evritin wey e dey do and e go show am plenty tins wey pass dis one and una go sopraiz.
I tell una true word, di time dey kom and e don even rish groun naw, wen doz wey don die go hear Man Pikin vois and wen dem hear am, dem go wake-up and dem nor go die again.
Wen Pita si sey all di pipol gada, e kon start to dey prish, “Israel pipol, wetin make dis mirakle dey sopraiz una like dis? Why una dey look us like sey na with awa own pawa or holiness wi take make dis man waka?
And I si di pipol wey don die, both big and small, as dem stand for di throne front. Dem open plenty books and den kon open anoda book wey bi di Life Book. And dem judge doz wey don die akordin to wetin dem rite for di books sey dem do.