Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 5:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 Bikos di Papa get strong love for en pikin, e dey always show am evritin wey e dey do and e go show am plenty tins wey pass dis one and una go sopraiz.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 5:20
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“My Papa put evritin for my hand. Nobody know di pikin, but na only en Papa know am. Nobody know di Papa, but na only di pikin and anybody wey di pikin choose to show.


As e still dey tok, one brite kloud kon kover dem and one vois kon sey, “Dis na my Pikin wey I love. Make una listin to am!”


Naim one vois from heaven kon sey, “Dis na My pikin wey I love and e dey make belle sweet mi.”


Den devil take Jesus go one mountin wey high well-well kon show am all di kingdom for dis world and all di betta tins inside am.


“My Papa don give mi evritin. Nobody know who di pikin bi escept di Papa and nobody know who di Papa bi escept di pikin and pipol wey di pikin choose to show.”


Nobody don fit si God face before. But Jesus, wey bi God ensef, wey en and en Papa bi tait friend, na-im kom show us how God bi.


So Jesus tell dem, “I don do many good tins wey una si from my Papa, wish one make una won stone mi so?”


I tell una true word, di pesin wey bilive mi, go do di kind mirakle wey I dey do and e go even do di ones wey big pass dem, bikos I dey go meet my Papa.


I nor go koll una savant again, bikos savant nor dey undastand wetin en oga dey do, but I dey koll una my friend, bikos I don show una evritin wey I hear from my Papa.


I don help dem know yor name and I go dey try to make oda pipol know am too, so dat di love wey yu get for mi, go dey with dem, as I dey with dem.”


God love en pikin well-well and E gi-am pawa to kontrol evritin.


As di Papa get pawa to take wake pesin wey don die, na so too di pikin get pawa to give life to anybody wey en won give.


I tell una true word, di time dey kom and e don even rish groun naw, wen doz wey don die go hear Man Pikin vois and wen dem hear am, dem go wake-up and dem nor go die again.


and di angels go kon separate di pipol wey do good tins, so dat dem go enter life wey nor dey end, but God go kondemn di pipol wey dey do bad tins.


God gi-am honor and glory wen di vois sey, “Dis na my Pikin wey I love and e dey make belle sweet mi.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ