36 God go reward di pesin wey plok plenty fruit from wetin odas plant and e go get life wey nor dey end. So, di pesin wey plant and di pesin wey plok wetin dem plant, go happy togeda.
Pesin wey bilive di only pikin wey God get, go get life wey nor dey end. But pesin wey nor bilive Man Pikin, nor go get life at-all. God go always dey vex with dat kind pesin.”
But anybody wey go drink from di wota wey I go gi-am, nor go hongry for wota again, bikos di wota wey I go gi-am, go turn to river wey nor dey dry inside en belle and di wota go gi-am life wey nor dey end.”
“I tell una true word, di pesin wey take wetin I tok and bilive sey na di Papa send mi, go get life wey nor dey end and e nor go enter hell-fire, but e go get life wey nor dey end.
My brodas and sistas, I wont make una know sey I don plan to kom visit una many times, but God nor let mi kom until naw. Bikos I won gain from una faith as I don do with Gentile pipol.
Make yu wosh as yu dey live yor life and di tins wey yu dey tish. Get patient, bikos if yu dey do like dis, yu go save yorsef and doz wey dey listin to yu.