E waka go front small kon liedan face groun, den e kon pray, “My Papa, if yu wont, yu go fit remove dis deat from mi! But nor bi as I wont, na as yu wont am.”
I nor go fit do anytin with my own pawa, but na wetin I dey hear from my Papa, naim I dey use take judge. Any judgement wey I give, na true one, bikos I nor dey do my own tin, but I only dey do as my Papa send mi.
But I get pesin wey go bear witness about mi wey big pass John, bikos di work wey my Papa give mi make I do, naim I dey do so; so di work dey bear witness sey, na my Papa send mi.
Like dis, I don show una sey wi must help pipol wey dey weak and una remember wetin Jesus Christ tok, wen e sey, ‘E betta make pesin dey give pipol tins, dan make e dey kollect from dem.’ ”
Make wi dey look Jesus Christ wey give us awa faith and go help us keep am. Bikos of di joy wey Jesus dey espect, e sofa for cross and nor mind di shame wey follow am. But naw, e don sidan for di rite hand side for God throne.