33 Di disciples kon dey ask demsef, “Abi somebody don bring sometin for am to chop wen wi nor dey here?”
Wen day break, Jesus koll en disciples kon choose twelf among dem wey e koll apostles:
But dem nor undastand dis word, bikos God hide am from dem make dem for nor know wetin di word mean. Di disciples demsef dey fear to ask Jesus about di matter.
Andru, Simon Pita broda, na one for di disciples wey hear wetin John tok kon follow Jesus.
Dem invite Jesus and en disciple for di marriage too.
But e tell dem, “I get food wey I go chop wey una nor know about.”