26 Jesus kon tell am, “Na mi wey dey tok to yu so, bi di Mezaya.”
Den Jesus kommand en disciples make dem nor tell anybody sey, na-im bi di Mezaya.
Abi I nor fit use wetin bi my own as I like? Or yu dey jealous bikos I dey do good tin?’
Den doz wey bi last, go bi first and doz wey bi first, go bi last.”
“I don tell una before e go happen, so dat wen e happen, una go bilive sey na mi bi Christ.
Na dis make mi sey una go die inside una sin. Unless una bilive sey, ‘Na mi bi di pesin wey I tok sey I bi’, una go die inside una sin.”
Den Jesus sey, “Wen una don karry mi put for cross, una go know who I bi. I nor just dey do anytin wey I like, but I dey always do wetin my Papa tell mi.