25 Di woman ansa, “I know sey di Mezaya (di one wey dem dey koll Christ), wey go save evribody, go kom and anytime wen e kom, e go tell us evritin.”
Jakob born Josef wey bi Mary husband, dis Mary naim bi Jesus Christ mama.
So, wen dem don gada, Pilate ask dem, “Who una wont make I release give una? (Jesus) Barabas or Jesus Christ?”
So, Pilate kon still ask dem, “Den wetin I go do with Jesus wey dem dey koll Christ?” All of dem kon ansa, “Nail am for cross!”
Today, dem born una Savior for dis town wey David from kom, en name na Christ, wey bi di Oga God.
Netanel sey, “Tisha, true-true, yu bi God Pikin and na yu bi Israel king.”
“Make una kom si one man wey tell mi all di tins wey I don do. Dis man nor bi di Mezaya so?”
By dis time, many pipol from Samaria town kon bilive am, bikos of di tins wey di woman tok, “E tell mi all di tins wey I don do.”
Den dem kon tell di woman, “Nor bi wetin yu tell us make us bilive, but bikos wi don take awa own ear hear and wi don know sey, dis pesin true-true, na-im go save all di pipol wey dey dis world.”