Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 4:24 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

24 God na Spirit and di pipol wey won serve am, must serve am for di true way wey God Spirit go show dem.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 4:24
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God dey klose to all di pipol wey dey koll am for help; Yes! E dey klose to evribody wey dey koll am with klean mind.


But to dey give tanks, na di kind sakrifice wey dey sweet mi for body. So if una follow my kommand, I go show una how God salvashon bi.”


Di sakrifice wey Yu wont, na spirit wey dey honbol and dey obey Yu. My God, Yu nor go rijet pesin wey honbol and turn from en sin kom meet Yu.


If I gada sin for my heart, God nor go ansa or listin to mi.


Na mi bi di high and holy God, di Pesin wey go live forever. Where I dey stay, dey high and holy, but I still dey stay with pipol wey dey honbol and ready to turn from sin kom meet mi, so dat I go give dem mind and hope again.


But di time dey kom and e don even rish, wen di pipol wey won really serve God, go serve am for di true way, wey God Spirit go show dem.


Wi dey happy, bikos wi know sey di way wi dey live awa life for dis world and how wi dey bihave with una, dey show sey na God send us thru en pawa, nor bi human being own.


Na God bi di Spirit and anywhere en Spirit dey, pipol go dey free.


Na wi bi di really sekonsishon; di pipol wey dey woship God thru en Spirit; pipol wey dey happy inside Christ and wi nor dey put awa hope for wetin pipol dey do.


Make all di honor and glory bi God own forever and ever! Na-im bi di King wey nor dey die, di One wey nobody dey si and na only en bi God. Amen!


But God tell Samuel, “Make yu nor happy, bikos of how en face look, bikos nor bi en I choose. God nor dey si tins di way una dey si am. Pipol dey look pipol from how dem bi for outside, but God dey look pipol from how dem bi for dia heart.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ