12 Yu big pass awa grand-grand papa Jakob wey give us dis well, where en family and animals dey drink from?”
For judgement day, Sheba kween go kondemn di pipol for dis time, bikos e travel from far place kom hear Solomon wisdom. And naw, somebody wey big pass Solomon dey here with una!”
Jesus ansa, “Pesin wey drink from dis wota go always dey hongry for wota.
Awa papa dem serve God for dis mountin, but una kon tok sey, di place wey pipol suppose to woship God, na Jerusalem e dey.”
E kon rish one town for Samaria wey dem dey koll Saikar, wey near di land wey Jakob give Josef, wey bi en pikin.
Jakob well dey der too. Dat aftanoon, bikos Jesus don taya to waka, e kon sidan near di well.
Yu big pass awa papa Abraham and all di profets wey don die? Who yu tink sey yu bi sef?”
Just as dem dey praiz pesin wey build fine house, pass di house wey e build, na so too Jesus glory betta pass Moses own well-well!