10 Jesus ansa am, “If yu know wetin God gift bi and di pesin wey dey ask yu for wota so, yu for ask am and e go give yu di wota wey dey make pesin live forever.”
I go stand wait yu on-top one rock for Horeb. Wen yu rish der, make yu nak di rock and wota go kom out for di pipol to drink.” Moses do as God kommand am and di eldas for Israel si evritin wey e do.
Na mi wey bi God choose yu to show as I good rish. I go hold yor hands kon guide yu and I go give yu to my pipol Israel, just to fulfil my kovenant. And yu go bi lite to guide oda nashons.
Even bad animals go honor mi; jackals and ostrich go praiz mi wen I go make river flow for di desert, so dat di pipol wey I choose go get wota to drink.
Food and wota nor go hongry dem again. Sun and desert heat nor go burn dem again, bikos na di pesin wey love dem, go lead dem. E go lead dem go where wota for dey flow.
Bikos dem don born one pikin for us! God don give us boy pikin! E go bi awa ruler and dem go koll am, “Wonderful Advise, Mighty God, Everlastin Fada and di Prince wey bring peace.”
bikos my pipol don kommit two difren sin against mi: dem don leave mi wey bi di spring wey dey give dem fresh wota and dem dig one well for diasef wey nor fit keep and gada wota.
God sey, “For dat day, I go open one place where wota go for rush kom wosh David shidren-shidren and Jerusalem pipol from all dia sins and all di bad-bad tins wey dem dey do.
For dat day, na only fresh wota go dey rush kom out from Jerusalem. Half go-go di Dead Sea and di oda half go-go Mediterranean Sea. E go dey rush both for dry and rainin sizin.
“God love di pipol wey dey dis world well-well, so E kon send di only pikin wey E get to us, so dat anybody wey bilive am, nor go die, but e go get life wey nor dey end.
But anybody wey go drink from di wota wey I go gi-am, nor go hongry for wota again, bikos di wota wey I go gi-am, go turn to river wey nor dey dry inside en belle and di wota go gi-am life wey nor dey end.”
Jesus kon tell dem, “Na mi bi di bread wey dey give life. Pesin wey kom meet mi nor go hongry lie-lie and di pesin wey bilive mi, nor go hongry for wota again.
Na mi bi di bread wey kom down from heaven. Anybody wey chop dis bread go live forever. Na my flesh bi di bread wey I go give di pipol wey dey for dis world.”
God tell am, “Get up make yu go di street wey dem dey koll ‘Strait’ and wen yu rish Judas house wey dey der, make yu look for one man, en name na Saul and e kom from Tarsus. Yu go meet am dey pray for der.
Wi know sey God Pikin don kom and e don give us sense to know di trut about God. And wi dey inside en Pikin Jesus Christ. Na-im bi di real God and na-im bi di life wey nor go end.
E still tell mi, “God don do am finish! Na mi bi di Alfa and Omega, di startin and di ending. Anybody wey dey hongry for wota, I go gi-am wota wey dey give life and e nor go pay.
Di Spirit and di Bride sey, “Kom!” Make di pesin wey hear sey, “Kom!” And anybody wey wota dey hongry, make e kom; di pesin wey wont di wota wey dey give life, make e drink from am free of sharge.
Bikos di Lamb for di throne, go bi dia Shepad. E go take dem go drink from di river wey dey give life. And evry tears wey dey dia eyes, God go klean am komot.”