Naw, if I dey tell una about di tins wey dey for dis world and una nor fit bilive wetin I tok, how una go fit take bilive mi, if I bigin dey tell una about di tins wey dey for heaven?
Wen breeze dey blow, e dey go anywhere e wont, yu dey hear di sound wey e dey make, but yu nor fit know where e dey kom from or where e dey go. Na so e bi with evribody wey God Spirit born.”
But know dirty or yeye tin go ever enter di town. Pesin wey dey do bad or dey lie, nor go ever enter der, but di pipol wey go enter, na only doz wey dem rite dia name for di Lamb Life Book.