Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 3:33 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

33 But pesin wey bilive wetin e tok about God, bilive sey wetin God tok, na true.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 3:33
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make una nor work for food wey nor dey last, but for food wey go give una life wey nor dey end and dat kind food, na only Man Pikin go fit give una, bikos na-im God send kom.”


I get plenty tins to tok about wetin una dey do, but my Papa wey send mi, nor dey lie and na wetin E tell mi I dey tell pipol wey dey dis world.”


So, afta I don finish dis work kon dey sure sey di bilivers don get dia blessings for Jerusalem, I go visit una wen I dey go Spain.


But leta, dem sekonsaiz am. Dis sign show sey, bikos of en faith, God don si am as raitious pesin, so dat e go bi papa to evribody wey bilive God, pipol wey God don asept, even doh dem neva sekonsaiz.


If I nor bi apostle to oda pipol, at least I bi apostle to una, bikos na una bi di sign wey show sey I bi Jesus Christ apostle.


But as God dey faithful, wetin wi dey prish give una nor bi make e for bi just “Yes” or “No.”


and E don mark us as en own kon put en Spirit for awa heart, so dat wi go dey sure of all di oda tins wey E sey E go give us.


Since una don hear di trut kon bilive Christ, God don give una di Holy Spirit as special mark to show sey naim get una.


Make una nor do wetin go make di Holy Spirit vex. Bikos na di Holy Spirit bi di mark wey God put for una body, so dat for judgement day, E go know doz wey E go save.


But God strong foundashon still stand and dem rite put sey, “God know en pipol and evribody wey bi Christ own, must stop to do evil.”


So wen God won show en pipol sey E nor go break en promise, E kon swear with ensef.


If wi sey wi nor dey sin, dat mean sey, God dey lie and di trut nor dey inside us.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ