Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 3:30 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

30 Pipol must know Christ pass as dem know mi.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 3:30
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So, I go honor and put am for where great men dey, bikos na only en sakrifice en life and dem si am as sina too. E karry evribody sins for en head kon pray so dat God go forgive us.


En royal pawa go kontinue to grow. En kingdom go get peace forever. E go rule well like King David kon do betta tins with en pawa; e nor go opress pipol and E go rule from naw go rish wen di world go end. God Almighty go do all dis tins.


Di pesin wey won marry new wife naim bi di bridegroom. En friend, wey bi di best man, dey listin to am. E go dey happy well-well wen e hear di bridegroom dey tok. Na dis dey make mi happy and my joy don full.


“Di pesin wey kom from heaven betta pass evribody wey dey for dis world. And who dey dis world, dey tok about di tins wey dey inside di world.


Mi and Apollos na God savant and E use us take prish to una make una for fit bilive, so mi and am dey do di work wey God sey make wi do.


Na-im bi head for di body wey bi di church and from di biginnin, na-im bi di first-born wey raiz-up from grave, so dat e go bi nomba one for evritin.


Di sevent angel blow en trumpet and one loud vois kon shaut from heaven: “All di kingdom for di world don bi God and Christ own. E go rule forever and ever.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ