23 John dey baptize for Aenon, one town wey near Salim, bikos plenty wota dey der and pipol dey kom meet am make e baptize dem.
Afta e don komot from Paddan Aram, Jakob kon rish Shekem town wey dey for Kanaan and e stay near di town.
Una wey dey stay along Babilon river, una end don near well-well. Una wey rish well-well with propaty wey una tif, dis na di time to kill una.
Yor mama bi like vine wey dem plant near wota wey get fresh leaf and dey bear good fruits.
and I kon si Israel God glory dey kom from di east. God vois sound like nois from sea and en glory shine kover di eart.
So John tell di pipol wey kom make e for baptize dem sey, “Una wey bi snake shidren! Who warn una make una run komot from God ponishment wey dey kom?
Leta, Jesus and en disciples go Judea aria and dem kon stay der for sometaim dey baptize pipol.
(For dis time, dem neva put John for prison).
En legs bi like bronze wey dem polish for fire and en vois bi like di nois wey sea dey make.
And I hear one loud vois from heaven like wave for sea or tonda for sky. I hear anoda sound like harp wey dem dey play.
Den I hear many pipol vois wey bi like river and tonda nois dey shaut: “Halleluya! Na awa Oga God wey get all pawa dey rule!
So Saul cross Efraim hill kountries kon pass thru Shalisha land, but dem nor si di donkey.