22 Leta, Jesus and en disciples go Judea aria and dem kon stay der for sometaim dey baptize pipol.
By dis time, di Jew Passova Feast don near well-well, so Jesus kon go Jerusalem.
Dem invite Jesus and en disciple for di marriage too.
John dey baptize for Aenon, one town wey near Salim, bikos plenty wota dey der and pipol dey kom meet am make e baptize dem.
Some among dem go meet John kon tell am, “Oga God, di pesin wey dey with yu for di oda side for Jordan River, wey yu tok about before, en too, dey baptize pipol and evribody dey rush go meet am.”
Jesus brodas kon dey tell am, “Komot for here go Judea, make yor disciples si di mirakles wey yu dey do.