19 Na dis bi di rizin why God go judge di world, bikos lite don kom inside di world, but pipol like to stay for darkness instead of lite, bikos dem dey do tins wey nor good.
From pipol wey live good life before dem bigin do bad-bad tins;
Just as dem dey do one wiked tin finish, na so dem dey start anoda one. Dis pipol nor gri listin to mi wey bi God.”
di eagle owl, owl wey en ear short or long, any kind hawk,
e go look am. If white sore dey di skin wey turn di hair to white and e get plenty pus,
If Egypt pipol and all di oda nashons nor gri celebrate di Shelta Feast, all dis ponishment go follow dem.
“Di savant wey know wetin en oga wont and e nor do am, dem go flog am well-well.
Wen di Farisee pipol (wey like money) hear dis one, dem kon dey take Jesus make yeye.
Na inside am life dey and na dat life bi di lite wey pipol get.
Di lite dey shine inside darkness, but darkness nor gri with am.
Di time to judge di pipol for dis world don rish and God go drive Satan, wey dey kontrol dis world komot.
Bikos Jew pipol like make pipol dey praiz dem pass wetin God tink about dem.
I kom as lite for dis world, so dat anybody wey go bilive mi nor go waka inside darkness.
How una go fit bilive wen una dey praiz each oda and una nor kare for di praiz wey only God fit give.
Anybody wey ready to do wetin God wont, di pesin go know weda wetin I dey tish na from God or na my own.
Pipol like una, but dem nor like mi, bikos I dey tell dem sey wetin dem dey do nor good.
Den Jesus sey, “Na mi bi di lite wey dey di world, anybody wey follow mi, nor go waka for darkness lie-lie, but e go get di lite wey go gi-am life.”
As far as I dey inside dis world, na mi bi di lite for di world.
Aldo dem know sey God law sey, pipol wey dey live like dat go die, yet dem nor only dey do dis tins, but dem even dey support pipol wey dey do am.
But E go show en vexnashon and ponish doz wey bikos of long-trot rijet di trut kon dey do bad tins.
Den God go distroy dem, bikos dem enjoy sin instead of di trut.
Na-im bi di rock wey dey fall pipol, bikos dem nor fit jump am pass. As dem nor bilive God word, dem bigin fall, bikos na so E plan sey e go bi.
Afta dis, make una undastand sey: for di last days, yeye pipol go kom and dem go dey do bad tins wey dey hongry dem.