Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 21:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 Jesus ansa am, “Make yu mind yor own business. If I wont sey make e stay until I kom back, wish one koncern yu inside? Make yu yorsef follow mi.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 21:22
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den Jesus tell en disciples, “If anybody won follow mi, e must deny ensef, karry en cross and follow mi.


Just as tonda lite dey kom from east go west, na so e go bi wen Man Pikin go kom.


As Jesus sidan for Mount Olives, en disciples kom meet am for korna ask am, “Make yu tell us wen dis tins go happen? How wi go take know sey di time wen yu go kom, don rish?”


So, make una dey ready, bikos Man Pikin go kom for di time wen una nor tink sey e go kom.


“Wen Man Pikin and en angels go kom with en glory, e go sidan for en king throne.


Jesus ansa am, “Follow mi, make doz wey don die beri dia dead body.”


Jesus kon tell dem, “I tell una true word, some pipol dey here wey nor go die until dem don si God Kingdom and en pawa.”


(Jesus tok dis to show how Pita go die, so dat God go get honor). Afta Jesus tok finish, e kon tell Pita, “Make yu follow mi.”


Wen Pita si am, e kon ask Jesus, “Oga God, wot about dis man?”


Jesus mean sey, wen una chop di bread kon drink from di cup, una dey tell odas about Christ deat until e go kom back.


So, make una nor judge anybody until Christ go kom back. E go espose evritin wey dey darkness and di tins wey dey inside pesin heart. Dat time, na God go praiz evribody akordin to wetin dem do.


Nor bi una bi awa hope, joy and crown wey wi go take boast give Jesus wen E kom? Yes! Na una!


My brodas and sistas, make una get patient till Christ go kom back. Tink how farmer dey wait for wetin e plant until e grow kon bring food wey dear and e dey wait with patient for am, until di first and di last rain go fall put.


So, make una get patient too and make una heart strong, bikos di time wen Christ go kom back, don near.


(Make una look! E dey kom back inside di kloud and evry eye go si am. Even doz wey shuk am and all di tribes wey dey dis eart, go kry bikos of am. Dis tins go really happen! Amen.)


Di Pesin wey dey tok dis tins, know sey dis tins na true. Jesus Christ sey, “True-true, I go soon kom!” Amen! Oga God Jesus, make yu kom!


(Si! I go soon kom! God don bless di pesin wey go obey di profesy wey dey dis book.)


I go soon kom. Make yu whole wetin yu get well-well, so dat nobody go take yor crown from yu.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ