21 Wen Pita si am, e kon ask Jesus, “Oga God, wot about dis man?”
Wen Pita turn round, e kon si John, (di disciple wey Jesus love well-well), dey follow dem. (Dis na di disciple wey bend en head near Jesus chest wen dem dey chop kon ask am, “Oga God, who bi di pesin wey go sell yu give yor enemy?”)
Jesus ansa am, “Make yu mind yor own business. If I wont sey make e stay until I kom back, wish one koncern yu inside? Make yu yorsef follow mi.”