Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 21:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 Wen dem don chop finish, Jesus ask Simon Pita, “Simon, John pikin, yu love mi pass all dis tins?” E ansa, “Yes, Oga God! Yu know sey I love yu.” Jesus kon tell am, “Make yu feed my sheep.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 21:15
49 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Jakob kon tell Esau, “My oga, yu know sey di shidren still small and I dey kare for di animals wey just born, if wi sey make wi travel with dem for just one day, all di animals fit die.


Wetin I go tell Yu again? Yu know mi well-well, but Yu still dey respet mi wey bi yor savant.


“My Oga God, make Yu remember sey I don serve Yu with all my mind and I dey always try to do evritin wey Yu wont make I do.” Den e start to kry well-well.


E go kare for en animals just as shepad dey do. E go gada di lamb togeda kon karry dem for en hand; E go lead and guide dem.


I go choose rulers wey go kare for dem. My pipol nor go fear at-all and I nor go ponish dem again. Mi, wey bi God, don tok.”


I go give una kings wey go obey mi and dem go rule una with wisdom and undastandin.


“I go give dem king wey bi like my savant David, wey go bi dia shepad and e go kare for dem.


Den di man kon tell mi, “Na dis bi di kishin where di temple savant go for boil di sakrifice meat wey di pipol offa.”


“Anybody wey love en papa, mama and pikin pass mi, nor go fit bi my disciple.


Den Jesus tell am, “God go bless yu, Simon, Jonah pikin, bikos na my Papa for heaven show yu dis tin, nor bi human being.


“Make sure sey una nor porshu any of dis small shidren komot. I tell una di trut, dia angels dey my Papa front for heaven evritime.


Pita kon ansa am, “If odas run leave yu, mi, I nor go ever leave yu!”


Pita still ansa, “Even if I go die, I nor go ever deny yu.” And all di disciples still tok di same tin.


Pita kon sey, “Even if odas run leave yu, I nor go run leave yu o-o!”


“Make una nor fear, una wey bi small sheep, bikos una Papa go happy to give una di kingdom.


But Simon, I don pray for yu make yor faith nor for fail. Wen yu don turn back kom meet God, make yu help yor brodas too.”


Andru kon bring Simon kom meet Jesus. Wen Jesus si am, e tell am, “Yu bi Simon, John pikin, na Cefas (wey mean Pita) pipol go dey koll yu from today go.”


Pita ask am, “Oga God, why wi nor go fit follow yu naw? I ready to die bikos of yu!”


My Papa love una, bikos una love mi and bilive sey na-im send mi.


Jesus tell dem, “Make una kom chop.” But dem nor fit ask am, “Who yu bi”, bikos dem bilive sey na Jesus e bi.


Den, John, di disciple wey Jesus love kon tell Pita, “Dis man na Jesus o-o.” Wen Simon Pita hear sey di man na Jesus, e kon kwik-kwik tie en klot well (bikos e nor wear anytin under), den e jump inside di river.


Den Jesus ansa, “If to sey na God bi una Papa, una for like mi, bikos I kom from God and as I dey so, I nor kom do my own tins, bikos na-im send mi.


Make una take kare of unasef and all di pipol wey di Holy Spirit don put under una, bikos na una bi di leaders for God church wey E buy with en only pikin blood.


I know sey afta I don go, wiked pipol with bad mind go kom join una and dis pipol nor go sorry for di ship.


Make una dey welkom God pipol. Even doh dia faith nor too strong, make una nor curse dem, bikos of wetin dem dey tink sey dey good or bad.


If awa faith dey strong, den make wi dey patient with doz wey get weak faith. Make wi try to make dem happy, instead of awasef.


Den wetin yu know don distroy pesin wey Christ die for.


For Christ, e nor matter weda dem sekonsaiz pesin or not; di only tin wey matter, na faith wey dey work thru love.


So make wi nor bi like shidren wey breeze dey karry up-and-down; shidren wey dey follow yeye tins wey human being dey tish and na dis tins dem dey take deceive pipol.


Make God grace dey with evribody wey love awa Oga God Jesus Christ with di love wey nor dey die.


God wey get peace, di Pesin wey use di everlastin kovenant blood bring awa Oga God Jesus Christ kom back from deat; awa Oga God wey dey look di sheep,


Nor-tin wey God kreate fit hide from am and evritin dey naked to God, bikos wi go must tell am how wi live awa life.


Aldo una neva si am, but una love am. Una nor dey si am naw, but una bilive am, una get happiness and glory wey una nor go fit esplain.


But make una dey hongry for spiritual milk like pikin wey dem just born, so dat una faith go strong well-well


Before-before, una waka komot for di rite road like sheep wey lost, but naw, una don turn back go meet di Shepad and Pesin wey dey guide una soul.


Bikos God first love us, naim make us dey fit love each oda.


Anybody wey bilive sey na Jesus bi Christ, don bi God pikin and anybody wey love di Papa, love di pikin wey E born.


I go kill all en shidren, den all di church pipol go know sey, I know wetin dey for pipol mind and heart. I go reward evribody akordin to wetin e do.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ