5 E nor enter inside di grave, but e bend down kon si di linen klot wey dem take wrap Jesus body for groun inside di grave.
Den Lazarus kom out, but di klot wey dem take beri am still kover en body. So, Jesus tell dem, “Make una luz di klot komot for en body, make e dey go.”
Den dem pour di perfume for Jesus body kon wrap am with linen klot akordin to di way Jew pipol dey prepare dead body for beri.
But Mary stand for outside di grave dey kry. As e still dey kry, e kon bend down look inside di grave.
Di two of dem kon dey run togeda, but John run pass Pita kon first am rish di grave.
Wen Simon Pita rish der, e enter inside di grave kon si di linen klot for groun too.