24 For dis time, Tomas (wey bi twins), one among di twelf disciples, nor dey der wen Jesus show ensef to dem.
Filip and Bartolomew; Tomas; Matiu, wey bi tax kollector; James, wey bi Afaeus pikin and Taddaeus.
Anywhere two or three pipol gada for my name, I go dey der with dem.”
So Tomas, (wey bi Twins) kon tell di oda disciple, “Make wi follow am go, so dat wi go die with am.”
Tomas ask am, “Oga God, wi nor know where yu dey go, how wi go take know road?”
Simon Pita and Tomas (wey bi twins), with Netanel (wey en town bi Kana for Galilee), with Zebedee pikin and two oda Jesus disciples, kon gada togeda.
Jesus ansa, “Nor bi twelf of una I choose? But one pesin among una na devil pikin.”
(E tok dis one about Judas, wey bi Simon Iskariot pikin, bikos na dis Judas, wey bi one among en twelf disciples, naim go sell am give en enemy.)
Make wi nor stop to dey meet and fellowship togeda, as some pipol dey do, but make wi enkourage one anoda more-more, since wi know sey, “Di Day wen Christ go kom,” don near.