Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 20:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 Den Jesus tell dem again, “Make peace dey with una. As my Papa send mi, na so I send una too.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 20:21
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“Si! I dey send una go like sheep for where plenty wiked animals dey, so make una dey wise like snake and gentol like dove.


“Pesin wey welkom yu, welkom mi too and anybody wey welkom mi, welkom di Pesin wey send mi.


As dem still dey tok, Jesus kon stand with dem, tell dem, “Make peace dey with una.”


I dey tell una true word, anybody wey receive di pesin wey I send, don receive mi and anybody wey receive mi, don receive God wey send mi kom.”


Make una mind rest, bikos na my peace I give una. My peace difren from di one wey di world dey give. Make una nor fear or allow anytin worry una mind.


Dat evening, for di first day for di week, en disciples kon gada togeda. Dem lock di door for di house wey dem dey, bikos dem dey fear di Jew oga dem. Jesus stand among dem kon sey, “Make peace dey with una.”


Wen e tok finish, e breath for dia body kon sey, “Make una receive di Holy Spirit.


Afta eight days, wen all di disciples gada again inside di house and Tomas dey der with dem dis time, even doh sey dem lock all di doors, Jesus show ensef kon stand among dem sey, “Make peace dey with una.”


God nor send en pikin kom kondemn di pipol wey dey inside di world, but make e kom save dem.


until di day wen God kon karry am go heaven, afta e give orda to di apostles, wey e choose with di Holy Spirit.


but una go get pawa wen di Holy Spirit don enter una life and una go tell pipol about mi for Jerusalem, for evriwhere for Judea and Samaria go rish all di far place wey dey dis world.”


Di tins wey yu hear mi tok for pipol present, make yu tish oda pipol wey yu trust sey dem dey ready to tish odas.


My brodas and sistas wey God choose, make una tink about dis Jesus wey God send kom and na-im bi di High Priest wey wi bilive.


I dey hope sey I go soon si yu and wi go tok face-to-face.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ