14 Afta e tok finish, e turn round kon si Jesus stand for der, but e nor know sey na Jesus bi dat.
Josef know en brodas, but dem nor know am.
But Jesus Christ meet dem for road kon tell dem, “I greet una o-o!” Dem dress near am, hold en leg kon woship am.
Afta, Jesus still appear to two pipol as dem dey waka go town.
[For early morning on Sunday, afta Jesus don wake-up, e first appear to Mary Magdalin wey e drive seven demon komot for en body.
(but Jesus nor let dem know who e bi.)
At wons dia eye open and dem kon know am. Den e vanish from dia front.
But Jesus pass dia centre, waka komot.
Wen day break, Jesus stand for di wotaside, but di disciples nor know sey naim dey der.
Den, dem kon pick stone won stone am, but Jesus hide kon komot from di temple aria.