Den di Word kon shange to pesin and e stay with us for dis world. Wi si en glory wey show sey, naim bi di only pikin wey get korrect favor and trut, wey God send kom meet us.
So wen Jesus don wake-up from deat, en disciples kon remember sey, e tok so before. Den dem kon bilive wetin dem rite for God word and wetin Jesus tell dem.
Wish kind business God Temple and juju get? Bikos wi bi God Temple, just as God sey, “I go stay inside dem and waka among dem, den, I go bi dia God and dem go bi my pipol.”