From dat time go, Jesus kon dey tell en disciples sey, e go must enter Jerusalem where di eldas, priest oga dem and di law tishas go sofa and kill-am, but for di third day, e go wake-up.
dey sey, “Yu wey sey yu go distroy di temple kon build am back for three days, make yu save yorsef! If yu really bi God Pikin, make yu kom down from di cross!”
Pipol wey dey waka pass kon dey shake dia head and dey tok bad about am sey, “Eehen! Yu wey sey, yu go fit distroy di temple kon build am again for three days.
Den Jesus bigin tish dem sey, “Man Pikin must sofa many tins, bikos di eldas, di priest oga dem and di law tishas go kill-am and afta three days, e go wake-up from deat.”
Naim Jesus ansa dem, “Make I tell una true word, di Pikin nor fit do anytin with en own mind, escept di tins wey e si en Papa dey do. And na anytin wey e si en Papa dey do, naim e dey do too.
If God Spirit wey raiz Jesus Christ from deat dey inside una, den en wey raiz Christ from deat, go give una body life, bikos of en Spirit wey dey inside una.