7 Di Jew oga dem ansa, “Wi get law and di law sey, e suppose to die, bikos e sey en na God Pikin.”
But E bear di sofa and pain wey suppose bi awa own. But wi tink sey en sofa na di ponishment wey God gi-am.
and pesin wey use God name anyhow, must die. Israel pipol go stone am weda na strenja e bi or not; anybody wey use God name anyhow, go must die.
Wen di soja wey stand for Jesus front si how e take die, e kon sey, “True-true dis man na God Pikin!”
Wen Pilate hear wetin dem tok, fear kon katch am well-well.
Bikos of dis, di Jew oga dem kon dey try to kill-am, bikos dem sey e dey break di Sabat law and e dey koll God en papa, like sey en and God na mate.
Dem sey, “Dis man dey bribe pipol to woship God and dat tin dey against awa law!”
and naim bi my only Pikin wey I wake-up from deat with di Holy Spirit pawa.
But any profet wey tok wetin I nor send am or tok about any oda god, go die.