Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 19:34 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

34 But one soja kon take spear shuk di korna of en belle, den blood and wota kon dey rush kom out.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 19:34
23 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So make Yu klean mi from my sins and I go dey klean; make Yu wosh mi and I go white pass snow.


I go pour klean and good wota for una body, so dat una go dey klean from di juju wey una dey woship before and evritin wey make una dirty.


“Den I go pour my spirit to pray and to show mesi for David shidren-shidren body and di oda pipol for Jerusalem. Dem go dey look mi, di pesin wey dem shuk, den dem go mourn like pesin wey dey mourn en only pikin. Dem go kry well-well like sey na dia first boy pikin die.


God sey, “For dat day, I go open one place where wota go for rush kom wosh David shidren-shidren and Jerusalem pipol from all dia sins and all di bad-bad tins wey dem dey do.


Di next day (wey bi Sabat Day) di priest oga dem and di Farisee pipol kon gada for Pilate front


But wen dem rish di cross wey Jesus dey and si sey e don die, dem nor kon break en leg.


Wen e don tok finish, e show dem en hand and di korna for en belle wey dem shuk with spear. Den di disciples kon happy well-well, wen dem si Jesus.


Naw, wetin yu dey wait for? Get up, make dem baptize yu, so dat God go forgive yu yor sin, as yu koll en name.’


Una don bi Christ friends bikos of God and na thru Christ wi get wisdom, goodness and holiness wey kom from God;


Na so some among una bi before, but naw, God don wosh una klean thru Jesus Christ name and en Spirit pawa, don make una klean for en eye.


so dat e go fit make am klean, thru baptizim and God word.


E die for us, so dat e go free and klean us from wikedness kon turn us to en own pipol wey like to do good tins.


If goat or ram blood and ashes fit klean pesin akordin to di old tradishon,


True-true, akordin to di law, na almost evritin blood dey make klean and if dem neva pour blood, God nor go forgive dem dia sins.


Dis show how baptizim go save us, nor bi just to wosh dirty komot for pesin body, but na to show sey wi get good mind for God thru di way wey Jesus Christ take raiz-up


Na Jesus Christ kom dis world with wota and blood. Nor bi only with wota, but na with di wota and di blood. And God Spirit bear witness sey dis na true, bikos na God Spirit bi di trut.


God Spirit, di wota and di blood and dis three witness dey tok di same tin.


and from Jesus Christ, di witness wey dey tok trut; di first-born among doz wey God raiz from deat and naim bi di King of all kings. Christ wey love and free us from awa sins with en own blood;


I kon ansa, “My oga, na yu know di ansa.” Den e sey, “Dis pipol die bikos of Christ. Dem don use di Lamb blood take wosh dia klot, naim make am white like dat!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ