Before dem do di Passova Feast, Jesus know sey en time don rish wen e go komot for dis world go meet en Papa. Bikos e love di pipol wey dey di world, e kon show dem how en love for dem strong rish.
So di sojas tell each oda sey, “Make wi nor tear am, but make wi gambol to si who go take am.” Dis tin happen to show sey, wetin dem rite for God word na true sey, “Dem go divide my klot, afta dem don gambol for am.” Dis na wetin di sojas kon do.