27 Den e tell di disciple, “Make yu look, dis na yor mama.” From dat time, di disciple kon take Jesus mama go en own house.
So naw, nor bi una send mi kom here, but na God. E don turn mi to Fero adviser, di oga ova all en propaty and di ruler for Egypt land.
Josef still provide food for en papa, en brodas, all en papa pipol, akordin to di shidren wey dem get.
“Den di king go ansa, ‘I tell una true word, just as una do am give di pesin wey small pass among my brodas and sistas, una don do am for mi.’
Den e look di pipol wey sidan round am kon tell dem, “Na my mama and my brodas bi dis pipol wey sidan here!
Den Pita sey, “Oga God, wi don leave evritin wey wi get kon follow yu!”
E kom meet en own pipol, but dem nor wont am.
Look, di time dey kom and e don even rish, wen una go skata and evribody go-go en own way and I go stay alone. But I nor dey alone, bikos my Papa dey with mi.
kon tell dem bye-bye and as wi enter ship, dem kon go back to dia house.