10 So Pilate kon sey, “Yu nor won tok to mi? Yu nor know sey I get pawa to free or kill yu?”
Yor papa great well-well, sotey all di pipol, nashon and language dey shake and fear am. E dey kill who e won kill kon honor who e like honor or disgrace who e won disgrace.
But as una custom sey make I free one prisona for una for Passova, una wont make I free Jesus, wey bi di Jew king?”
Jesus ansa, “Yu nor get pawa at-all for my life, escept God gi-am to yu. So, na di pipol wey bring mi kom meet yu, na dia sin big pass yor own.”
So e enter di house back kon ask Jesus, “Na where yu from kom sef?” But Jesus nor ansa am.