6 So wen Jesus don tell dem sey, “Na mi bi di pesin”, dem dress go back kon fall for groun.
So, make evribody wey hate Jerusalem, turn back with shame.
Wen wiked pipol and my enemies won kom attack and kill mi, dem dey stagga fall.
Make shame and disgrace follow di pipol wey dey try to distroy mi. Pipol wey dey happy bikos I dey sofa, make disgrace follow dem.
Dem ansa am, “Na Jesus wey kom from Nazaret.” E kon tell dem, “Na mi bi di pesin.” (Judas wey sell am, stand der with dem).
Den Jesus ask dem again, “Who una sey una dey find?” Dem ansa, “Na Jesus wey kom from Nazaret.”