Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




John 18:37 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

37 Den Pilate ask am, “So yu bi king?” Jesus ansa, “Na yu tok so and yu dey korrect sey, I bi king. Na dis make dem born mi and naim make mi kom dis world kon tok di trut. Anybody wey wont hear di trut, go listin to wetin I dey tok.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




John 18:37
26 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I make am leader and kommander for many nashons and I show dem my pawa thru am.


Jesus ansa am, “Yu don tok am. But I tell yu, from naw go, yu go si Man Pikin sidan for God rite hand dey kom down for kloud from heaven.”


As Jesus stand for di govnor front, di govnor kon ask am, “Na yu bi di Jew pipol king?” Jesus ansa, “Na as yu tok!”


Jesus ansa, “Na mi and yu go si Man Pikin sidan for God rite hand, wen e dey kom inside di kloud from heaven.”


So Pilate ask Jesus, “Na yu bi di Jew pipol king?” Jesus ansa, “Na as yu tok.”


All of dem kon ask, “So, yu bi God Pikin?” Jesus ansa, “Na una tok am o-o.”


Pilate kon ask Jesus, “Na yu bi di Jew pipol king?” Jesus ansa, “Na as yu tok.”


Den di Word kon shange to pesin and e stay with us for dis world. Wi si en glory wey show sey, naim bi di only pikin wey get korrect favor and trut, wey God send kom meet us.


Na thru Moses God give us di law, but God give us favor and trut, thru Jesus Christ.


Jesus ansa am, “Na mi bi di road, di trut and life. Nobody go fit go meet my Papa, unless e pass thru mi.


But di pesin wey kom from heaven dey tok about wetin e si and hear for heaven, but pipol nor gri listin to am.


Anybody wey ready to do wetin God wont, di pesin go know weda wetin I dey tish na from God or na my own.


Jesus ansa dem, “Even if I dey tok about mysef, wetin I dey tok na true, bikos I know where I from kom and where I dey go. But una nor know where I from kom or where I dey go.


Na bikos I dey tell una true word, naim make una nor gri bilive mi.


Who among una go fit show sey I kommit sin? Since I dey tell una true word, why una nor won bilive mi?


Di pesin wey bi God pikin, dey listin and do wetin dem rite for God word. Una nor dey listin and una nor dey do wetin dem rite for God word, bikos una nor bi God Pikin.”


Before God wey dey give life to all tins and Jesus Christ wey tok well for Pontius Pilate front, I dey tell yu from my heart sey,


Una don klean una soul with di trut wey una dey obey and as brodas and sistas, make una love each oda well-well.


I nor rite give una, bikos una nor know di trut, but na bikos una know Christ and di trut dey stay inside am.


Wi know sey wi don cross from deat enter life, bikos wi dey love and kare for awa brodas and sistas for Christ.


Wetin wi dey do go show sey wi dey live for di trut, so wi go dey bold wen wi stand for God present.


Wi kom from God and di pesin wey know God dey listin to us, but pesin wey nor know God, nor dey gri with us. Dis na how wi take dey know di thru Spirit and di spirit wey dey deceive pipol.


Wi know sey God Pikin don kom and e don give us sense to know di trut about God. And wi dey inside en Pikin Jesus Christ. Na-im bi di real God and na-im bi di life wey nor go end.


Na John rite dis leta go give di seven church wey dey Asia aria. Make grace and peace dey with una from di Pesin wey dey since, wey dey naw and wey go still kom. From di seven spirits wey dey en throne front


“Make yu rite di tins wey I won tell yu naw, go give di angel for di church wey dey Laodicea: ‘Dis message na from di Pesin wey bi di Amen; di witness wey dey obey God kommandment since E kreate di world.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ