God sey, “Di time dey kom wen I go choose betta king from among David shidren-shidren. E go rule di land with wisdom kon do wetin dey korrect and good.
Zion pipol! Make una happy well-well! Jerusalem pipol! Make una shaut with joy! Make una look, una king dey kom meet una! E dey raitious and naim get viktory. E dey honbol and kwayet as E sidan on-top donkey dey kom.
dey akuiz am sey, “Wi hear dis man wen e dey deceive and tell awa pipol sey make dem nor pay tax give Caesar and e dey tok sey naim bi Christ, wey bi king.”
Di pipol take palm tree leaf go wait am for road. Dem kon bigin shaut, “Hosanna, make God bless di pesin wey E send kom meet us. Make God bless Israel king!”
Den Pilate ask am, “So yu bi king?” Jesus ansa, “Na yu tok so and yu dey korrect sey, I bi king. Na dis make dem born mi and naim make mi kom dis world kon tok di trut. Anybody wey wont hear di trut, go listin to wetin I dey tok.”
From dat time, Pilate kon bigin find way to free Jesus, but di Jew oga dem kon dey shaut, “If yu free dis man, yu nor bi Caesar friend. Anybody wey sey en bi king, na Caesar enemy e bi.”