26 One High Priest savant, wey bi di same family with di man wey Pita take swod kut en ear kon sey, “I nor si yu with am for inside di farm?”
Trut go last forever, but lie-lie nor dey tey before evribody go know sey na lie.
Afta sometaim, pipol wey stand for der, kom meet Pita tell am, “Yu really bi one of dem, even di way yu dey tok show sey yu dey with am!”
Afta sometaim, anoda pesin si am kon sey, “Yu dey with dem, nor bi so?” But Pita sey, “My friend! I nor dey with dem o-o.”
Afta e don tok finish, Jesus and en disciples komot cross go Kidron Valley kon enter one big farm.
Den Simon Pita bring en swod out kon kut di High Priest savant rite ear komot. (Di savant name na Malkus).