25 As Simon Pita stand for inside di kompond dey warm ensef, dem kon ask am, “Yu too nor bi one of en disciple?” Pita deny sey, “I nor dey among dem.”
Bikos Sarah dey fear, e kon deny sey, “Na lie! I nor laf.” But di Oga God kon sey, “No! Yu laf.”
E dey bad to borda yorsef about wetin pipol dey tink about yu, but if yu trust God, yu go dey save.
As Pita sidan outside for di yard. One girl wey bi savant kon tell am, “Yorsef bin dey with Jesus Christ wey kom from Galilee.”
For dis time, Pita dey for di varanda, den di High Priest girl savant kom der.
Wen dem don make fire for di kompond centre kon sidan togeda, Pita sidan with di pipol too.
One savant girl si Pita sidan near di fire, e look am for eye kon sey, “Dis man bin dey with Jesus too o-o.”
But Pita sey, “Woman! Nor bi mi, I nor know am.”