22 Afta Jesus don tok finish, one of di High Priest savant, wey stand near am slap am for face kon ask am, “Na di High Priest yu dey tok to like dis?”
Pipol dey curse and laf mi. Dem dey slap mi for face and dem don gada against mi.
e kon oda sey make dem beat and tie mi with shain, den put mi for one room near Benjamin Gate for di temple.
Jerusalem pipol, make una gada unasef like sojas, bikos enemies dey hide won kon attack una. Dem go use rod take nak Israel leaders face.
Den some bigin spit for Jesus body, dem tie en eye kon dey nak am dey sey, “Profesai naw!” Di pipol wey dey guide di place still join beat am.
Why yu dey ask mi? Make yu ask di pipol wey hear mi. Dem know wetin I tok.”
So Judas kon escort many soja, some Temple polise and Farisee pipol enter di farm. Dem whole lamp, tosh and some whole swod and stik for hand.
Dem kon dey laf am, dey take am make yeye, dey sey, “Make una kon si di Jew pipol king.” Dem slap am for face many times.